Ogbonge Naija record producer, Young Jonn (Di Wicked Producer) don port go Chocolate City Music.
Di record producer wey de also sing don carry him music career enter another level with dis new move.
Na Chocolate City make di announcement of him new contract with dem.
According to press statement wey EYESABI carry eye see, “di ogbonge producer and musical artist don ready to take over di world.”

Di young producer don de responsible for many many hit songs wey Naija people and music lovers all over di world don hear. Among him diverse catalogue include him works with Olamide, Lil Kesh, Naira Marley, Zinoleesky and many others.
To kick start him new journey for Choc City, di artist go make him debut tomorrow and him de currently work on him first EP.