Rivers State Govanor, Nyesom Wike, been no get joy with Ebonyi State Governor Dave Umahi.
On Friday Govanor Dave Umahi tok sey God go give Naija president “wey get good heart like President Muhammadu Buhari for the good of we kontiri” come 2023.

Di Govanor tok this thing when him been dey Aso Villa with General Buhari and state house correspondents.
Governor Wike been no get joy at all as him tok sey Dave Umahi suppose go psychiatric check.
Wike tok sey rivers generate N15bn for june come kollet N4.7bn but Kano generate N2.8bn and dem kollet N2.8bn.
Govanor Wike tok sey president Buhari no sey na lie dem dey lie for am.

Wike tok say even Buhari sef know say God no go gree for anoda presido like am.