Abdulwaheed Waliu, 400-level student of Department of Microbiology for university of Illorin, beat him project supervisor till she faint.
Word for street na say, di student provoke for him lecturer as she no gree help am ‘arrangy’ him SIWES wey him no do.
SIWES na compulsory Students Industrial Work Experience Scheme.
As di woman no gree help am, him start to dey slap her.
She try run comot from her office but him follow her reach from department.
Di beating too much for di lecturer sotey she collapse for front of di department.
Di student try escape but school security catch come hand am over to police.
As at di time of dis report di lecturer don regain consciousness.