UEFA don release Champions League draws for di season.
Di draws dey sweet fans dem belle.
Chelsea, wey win Champions league last year go play Juventus, wey be one of di top teams for Italy.
Paris Saint German, PSG, wey just grab world best player Lionel Messi from Barcelona FC, go face English champions Man City.

UEFA tok say teams wey from di same kontiri no fit play togeda and di table we dey see so, show say na true.
E get match wey all man put eyes ontop for group E.
Di match against Spanish giants Barcelona and German champions Bayern Munich.
Last year wey the two teams jam, Bayern nack Barcelona 8-2.
I sure say Barca no go want make dat kain tin happen again.
See di groups for down.

Group A
Manchester City
Paris Saint-Germain
RB Leipzig
Club Brugge
Group B
Atletico Madrid
Liverpool
Porto
AC Milan
Group C
Sporting CP
Borussia Dortmund
Ajax
Besiktas
Group D
Internazionale
Real Madrid
Shakhtar Donetsk
Sheriff Tiraspol
Group E
Bayern Munich
Barcelona
Benfica
Dynamo Kyiv
Group F
Villarreal
Manchester United
Atalanta
Young Boys
Group G
Lille
Sevilla
Salzburg
Wolfsburg
Group H
Chelsea
Juventus
Zenit St Petersburg
Malmo