BSC Young Boys Bern on Tuesday win Manchester United 2:1.
Even as Cristiano Ronaldo score on di 13th minute with Bruno Fernandes assist, e still been no dey enough to seal di match.
Aaron Wan-Bissaka collect straight red card for di 35th minute because of him careless tackle on top Christopher Martins.
Man U been solid for 55 minutes with 10 men as dem been dey draw.
Lingard come looseguard comit one very late defensive error wey cause Young boys second goal, just few seconds to di final whistle.
For other tori, Ronaldo don dey level with him former team mate Iker Casillas for all-time Champions League appearances (177).