As Naija people dey prepare for di general elections come February 2023, e dey expected say many tori go dey comot, today na for Tinubu.
On Sunday26 June 2022, Naija people don enta twitter to drag APC presidential candidate Bola Tinubu.
Social media users don dey ask make di presido aspirant drop him certificates of school wey he attend.
Few days ago toks comot say Tinubu yan say him school certifications dey miss.
But Naija people no dey buy dis one as dem tok say makehim provide all di neccessary documents to INEC.
Different tori don comot for twitter as to why he no gree drop di certificate but no body sabi di main reason.
Twitter people don tok say dem no need anoda assurance presido, but person wey ready to show us him real self.
As different tori dey comot, di people still dey advice make di masses go collect dia PVC.
As dis na di only way to get say for di coming elections.
See more twitter comments: