Nigeria Correctional Service (NCoS), confam attack on Jos prison on Sunday.
Dem confam am for press release.
Dia spokesman Francis Enobore, yan say di bad men infiltrate di prison yard around 5:20 p.m.
Dis heavilly armed men been engage di armed squad personnel for gun battle before dem enter di premisses.
Afta dem gain access, to di building dem enta serious gbege.
Meanwhile men from oda secuirty agencies, come mobilize resistance outside di main gate.
Di prison authority follow yan say di security agencies been
trap dis bad men inside di facility.
No confamation of arrest or casualties from di prison authorities concerning dis mata.
Rufus Bature, chairman of Plateau chapter All Progressives Congress (APC), on Monday condemn dis mata.
Him yan say govament must punish di attackers well-well.
Oga Bature commend di sharp response and collabo of di security agencies as na wetin we need to tackle insecurity.
Him commend di arrest of inmates wey try escape during di attack.
Di APC chairman charge federal govament to check di raise in jail breaks for di kontiri.