Julfa Zittas aka ‘Sabi Boi‘ don release new album.
The album name na ‘ExoDus‘ wey get seven (7) tracks wey man dem fit use jolificate.
Musicians wey collabo put hand for this album na; Loyz, Meph, Hadibah and, S7VN.
No be the first time wey Sabi Boi dey release project be dis.
For 2016, the ogbonge singer bin sama us with ‘The Genesis’ EP.
De EP bin carry ‘Noted’, one track wey dey totori for bodi.
To gbedu to de latest Sabi Boi album, check am HERE.