Naija people don enta twitter to tok dia mind for di former deputy speaker house or reps Ike Ekweremadu and him wife Beatrice arrest.
Police for di United Kingdom arrest both husband and wife sake of organ harvesting.
Di UK police tok say di Naija senator and him wife carry one pikin come to harvest di organ for dia sick pikin.
On Thursday, di UK police charge di couple to court for inside di kontiri.
Di court adjorn di mata till July 7th 2022, but dem tok say make di police hold di couple for custody.
Naija people don enta di social app to drop dia own mind for di mata.
Ekweremadu arrest dey come afta di big time politician tok few days ago say Igbo peopleno go vote Peter Obi.
Obi na aspiring presidential candidate unda di Labour Party for Naija.
Twitter people don tok say na sake of he bad mouth di presidential aspirant na why dem catch am.
See more comments: