Fans of popular Naija gospel Artist, Osinachi Nwachukwu don begin send tribute especially for social media to mourn di death of di gospel singer.
Di gospel singer wey dey her forties kpai on Friday for one Abuja hospital.
Bifor she kpai, Osinachi na singer and songwriter wey popular well-well because of her song “Ekwueme” wey she sing wit singer Prospa Ochimana.
Di gospel song get ova 71 million views for Youtube.
Osinachi don feature for songs like Nara Ekele by Pastor Paul Enenche and Ema “You no dey use me play”.
Bifor she kick bucket, she don also release new song wey she call “God of all power”.
Di gospel singer dey sing most of her songs wit Igbo language.
Osinachi leave behind her husband and four children and since di news of her death comot, fans don go social media to send tribute messages to di singer and her family.
Edwin Alex, wey be gospel singer say Osinachi death don deny am opportunity to get track wit di singer.
We pray say Almighty God go grant her eternal rest and give the family commfort.