As di Academic Staff Union of Universities (ASUU) extend dia strike by three months.
Naija people don go twitter to show dia vex wit the union and di govament.
ASUU Presido, Prof. Emmanuel Osodeke, yan say di union bin reach decision to give di govament enough time to resolve all dia issues wey remain.
Naija people don vex tok say di union and di govament no get good heart towards students.
Di kontiri govament and politicians dey seriously plan for 2023 elections and di younger generation just dey for house.
Human rights activist Aisha Yesufu, for her tweet remind young people wey dey carry politicians mata for head say, say di politicians no send dem.

Naija entrepreneur Dami Adenuga tok say “ASUU extend strike for three months. Everybody dey campaign, so ASUU no be problem for our leaders.”

For human right activist and publisher, Omoyele Sowore, di one wey pain am pass for di strike extension be say, e don dey go on for many for months now.
See oda reactions:
