Her Majesty Queen Silekunola Naomi don announce her divorce from di Ooni of Ife Oba Adeyeye Ogunwusi Ojaja II.
She use her Facebook page take announce dis mata.
Queen Silekunola yan say she no be queen of Ife again and she don decide to move on.
According to her she try her best to endure and make tins work out many times, she been dey smile during di struggle.
She follow yan say she realize say her only assignment na her son.
She yan say her marriage wey last for three years no be arranged marriage.
“I bless di Lord Almighty for im faithfulness for di last three years of my marriage. Life journey, no be how far.”
Meanwhile di queen been wan clear di impression say na because Ooni marry anoda queen she dey divorce am.
“Make una know say I make di decision to move on and no be sake of say his majesty marry anoda queen.”
“As far many go dey assume, throughout our life as couple, na only me be him married wife.”
“Side attractions bin dey, but no be issue,” she follow write for Facebook.