Premier League dis Saturday make sense as Man City carry Arsenal do yeye.
The English champions nack Arsenal 5-0 as Ferran Torres collect brace.
Mata come tie wrapper for the Gunners as Granit Xhaka collect red card for the match.
E be like this season go red for Arsenal oh!
For Anfield, Liverpool and Chelsea tie wrapper as dem draw 1-1.
But Reece James, Chelsea player, come mess wey make referee wipe am red card.
Make una see as Saturday matches end.
Man City 5-0 Arsenal
Aston Villa 1-1 Brentford
Brighton and Hove Albion 0-2 Everton
Newcastle 2-2 Southampton
Norwich 1-2 Leicester
West Ham United 2-2 Crystal Palace
Liverpool 1-1 Chelsea