Dis tori heavy pass eba!!!
Men wey get bear-bear, gada go Brekete Family to complain say church pastor, Harrison Anazodo Charles, don tiff dem wife.
Mr Charles na pastor for Day Spring Assembly.
Normal level, Ordinary presido, Ahmed Isah, give dem listening ears as dem carry dem complain come him radio station.
Di mata heavy to tok for mouth but EYESABI go yan una dey tori.
As dis men dey find solution to ‘dem trouser wey tear’, Ordinary presido share di mata for Twitter.
Make una follow di tori for down.
Terrible, but really happening