Nigerian comedian Osama, show say him dey him guy back.
Him confam d tori say Nedu first pikin no be him own.
Nedu na popular comedian and radio man for Lagos.
Dis na afta Nedu former wife drag am like tiger generator for Twitter.
Osama talk say na peperempe make Nedu comot her from hin house oh.
“She dey carry her babes dem come Nedu house come do lesbianism.
“Mata dey oh! because Oga Nedu even suffer Domestic violence for him own kaban,” na so Osama tok.
Water come pass garri as dem do DNA test.
Di test show say tru-tru, no be Nedu born him first pikin.
KASALA DON FULL GROUND!