National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don confam di arrest skit maker “De General”.
NDLEA say dem catch di skit maker wit tramadol and cannabis sativa.
Di tori bin break for early mo-mo, Wednesday.
D-General bin post am for Instagram live say NDLEA use wuru-wuru take enta him house to find drugs.
For di live wey almost two thousand people watch, e bin dey hala say; “I no get right to make video?, wetin you dey tok sef? make di world know wetin dey happun.”
Na raid di agency go when dem try nab some boys for Orchid estate, Lekki Lagos.
In di process, boiz dem tear race enta De General house.
As dem search, dem find 225mg of tramadol and some cannabis.
Dem say di clip wey dey trend for social media happun wen di suspect bin dey try show wetin dey occur for di live.
NDLEA further yan say De General confess say di drugs wey dem find for him house, na him get am.