Femi Fani-Kayode, wey be former Aviation Minister don tok say di bad people wey attack Afghanistan, Iraq, Syria and, Lebanon don come for Naija.
Oga Femi tok dis one for him Facebook page.
FFK follow yarn about di Major, Christopher Datong, wey di bandits kidnap.
FFK don dey tell Naija govament to do sharp-sharp close di kontiri boda so dat bad people no go enta Naija.
Tori wey dey reach us be say, di bandits dem dey ask for N200 million before dem go fit release am.
EYE SABI bin yarn una di tori when bandits attack NDA, kill some sojas come kidnap some odas.
See di post for down.