Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) talk say corona disease don dey increase for di kontiri and many people don dey die because of di yama yama sickness.
NCDC yarn say only on Saturday, 28th August, 2021, dem record 650 new case and 56 out of the 650 people don die.
Dem tok dis one for dia website on Sunday, 29th August, 2021.
According to tori from News Agency of Nigeria, di sickness dey increase for di kontiri and people wey don die now na 2,361.