Few days ago one Naija woman Ammerah_sufyan tweet SOS message for di app say dem kidnap her.
For di tweet wey she send, Ameerah tok say dem kidnap she and 17 people, wit 3 pregnant women for Abuja.
She yan say dem collect every body phone but she hide her own na why she fit drop message and location of wia dem dey.
Twitter people carry di mata as dem begin tag all possible sources wey fit locate her.
Police on Friday June 17th yan say dem don locate Ameerah_Sufyan.
Dem tok say she send out fake SOS and she just dey catch cruise.
Twitter people don enta di app to tok dia mind dis morning.
Users of di social app don tok say even if she catch cruise dem no dey dissapointed say dem help her.
Some people don also condem wetin she do, as dem tok say make police use her do example.
See more of di people comment:
Naija police don tok for tori say dem don find Ammerah_sufyan and she dey dia custody.