Minista of Informate and Culture, Lai Mohammed, done comot yarn say dem go soon lift di Twitter ban wey dem place.
Rememba say dis Buhari govament been ban Twitter because dem delete one of him tweet from dem platform.
Di minista yan am when him dey with journalist for Wednesday cabinet meeting wey Presido Buhari hold.
Oga Lai tok say govament and Twitter owners done dey talk tey-tey.
Hin yan say dem tok dey make sense and dem done dey reason to comot di ban.
Him describe di meeting as productive and quite respectful.
“Di time wey dem go bring Twitter back no go reach time wey dem ban am,” Oga Lai yan.