Dem don swear in Ferdinand Marcos Jr as di new presido of Philippine.
Ferdinand “BongBong” Marcos Jr swear him oath of office for Manila yesterday June 29,2022.
Marcos dey succeed outgoing presido Rodrigo Duterte.
Marcos Jr win di election last month wit wide margin and Sara Duterte, daughter of di outgoing president, gobe him vice-president.
Di inauguration mark comeback for Marcos political dynasty, afta one popular revolt for Philipines see dem comot office for 1986.
Marcos Jr take him oath of office for colourful ceremony wey happun for di National Museum.
Outgoing Presido Duterte receive am for di Malacanang presidential palace.
Di inauguration happun days afta di Supreme Court for Manila tok say convictions for tax evasion no disqualify di new presido from taking office.

Marcos Jr pay tribute to him father Ferdinand Marcos Sr wey rule di Philipines for two decades wit iron hand.
During Marcos Sr time as presido, he rule as dictator.
Marcos Sr time as presido end for 1986 wen di people of Philipine enta street to protest.
Since Marcos jr return to Philipines for 1991, he don promise day he go change di way wey people dey see him family for di kontiri.
He also promise to bring changes and strengthen relationship between Philippine and oda kontiris.