Music legend 2Baba, done comot yarn say time done reach wey our country go package ‘Pidgin English’.
Him yan say ‘Pidgin Englis’ na we own o!
Him yan di mata for Twitter; “Make we package this pidgin English tin o. Where all the linguistics profs at. Na the only one wey all of us sabi be that o.”
We gree say na Oyinbo man English na hin Naija people dey speak all ova.
When pikin enta school, na di language wey dem dey take teach am be dat.
But we also get our own unique English style and dat na ‘Pidgin English’.
As e be, plenty-plenty people already sabi speak am and fault no dey di language.
E no get who go laugh you say you no sabi speak pidgin. Any how wey you wan tok am, tok am!.
Na why we for EYE SABI done gree say ‘Pidgin English’ na we own and we dey bring una beta, correct latest tori, all for Pidgin English.