Liverpool dull Arsenal 2-0 for Emirates and dem go battle am out with Chelsea for di League cup final.
Trent Alexandra Arnold assist Diogo Jota twice to secure dia spot for di final.
Jota been first score for di 19th minute but Arsenal still try to dey di game.
Di second goal give di final blow as Jota score again afta slip up from Gabriel Martinelli.
Di final of dis cup tournament go hold on di 27th February 2022.
Chelsea hit Spurs comot to book dia own for di final wey go hold February.