Fly Boy Inc boss, Kizz Daniel and multi-talented artist Tekno don finaly bless fans wit di Buga video.
Dis one dey come as follow-up to Kizz recent EP, “Barnabas,”.
Kizz Daniel wey people sabi bifor as “Kiss Daniel” na Naija recording artist, performer and entertainer.
One of him best selling tracks wey carry popularize am na him song ‘Woju’.
Kizz don feature many star artist for inside di kontiri, fromlikes of Davido for “One Ticket” to Halleluyah wit ‘Simi’ and odas.
Buga see stars like comedian Sabinus and oda big big people for di industry.
Make una enjoy dis track wey still dey cause wave for di kontiri.