Bandits done release di 75 Zamfara school children wey dem kidnap.
Dem bin kidnap the children dem from Government Day Secondary School Kaya, for Maradun LGA of Zamfara state.
We no know if govament of di children pay ransom but Naija police done confam di report say the children done go gain freedom.
Zamfara State Police spokesman, Mohammed Shehu, been release statement say plenty armed Bandits been enter di school come carry 73 school children comot.
Meanwhile, di bandits first free five children, na so councilor tok.
Him tok say him niece dey part of di children wey dem release first.
EYE SABI report say di govanor of the state, Gov. Matawalle, bin para say him no go follow bandits do amnesty again.

As di bandits no gree embrace peace, na fire-for-fire approach him go use.
Him talk say make di indigenes dey patient as security agents go mess the bandits up.