JJC Skills di husband to Naija born actress and Jennifa’s dairy star Funke Akindele don announce dia separation.
JJC announce dis one for him instagram post today Thursday 30th June.
Di producer and di actress don dey married for about 7 years now.
For post wey JJC send on him in music producer and talent manager tok say him and Funke don decide to go dia separate ways.
Funke and JJC don dey married for almost 7 years.
Dis no be di Naija actress first marraige wey dey end like dis.
According to tori wey JJC skills post, he tok he wan alert di public say he and him wife funke don go dia seperate ways.
During di course of dia marriage dem share plenty things togeda, and dem even get twins.
JJC add say di last two years for dia marraige no sweet atall, and him don try to fix things but e no work.
Di music manager tok say Funke even ask am make he comot dia house 3 months ago.
JJC apologise to him fans and also he tok say he hope say he and Funke go try siddon tok things later.
So far di acrtess neva comot tok anything.
Also JJC son, Beni, don enta social media different times to tok say him father marraige no dey okay.

