Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don start drop results of di 2022 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).
Di exam wey start on 6 May end on 13 May 2022.
Di exam exercise hold for seven days for different part inside Naija.
Jamb Head of Public Affairs and Protocol, Fabian Benjamin na hin announce say di results don dey comot.
Mr Benjamin also add say make candidates dey careful as dem go receive messages from 419 people on how to check dia results.
He advise say make people shin dis message.
Benjamin tok say di board neva publish di Jamb results for dem website.
But students fit check dia results wit di phone number wey dem use register.
To check dia 2022 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) result;
- Di candidate go send UTMERESULT to 55019
- Candidate must use di same phone number wey e use register for di exam
- Jamb go send di result back to dat phone number as a text message.
Benjamin tok say dey use dis method to reduce stresl for students to see dia result.
Jamb na entrance examination for people wey dey find admission into public Universities for Nigeria.