Anambra state govanor, Willie Obiano, on Monday tok say him go punish people if dem no open market.
Dis one na sake of say him people obey IPOB to continue di ‘seat-at-home’ order.
Di state govament don waka enter street for Awka dey tell business people make dem resume business activities.
Dem also dey yan banks and markets to begin work from Monday.
“Di state no go give urchins power to dey control di helms of affairs of di state and I go start to fight molestation, harassments, intimidation,” Mr Obiano yan.
Gov. Obiano don threaten to close banks if dem no open for business.
Him go also punish markets and motor park leaders if dem no gree comot body for di IPOB ‘sit-at-home’ order.
Gov Obiano don talk say di sit at home order dey affect di economy of di state.