Herdsmen done attack anoda village for Kaduna state.
Di village wey dem attack na Apiye Jim for Atyap Chiefdom of Zango-Kataf LGA.
Punch Newspaper wey report the killings, yarn say e happen yesterday as heavy rain dey fall.
As wey dey tok, Naija police neva confam the mata.
But di Southern Kaduna Peoples Union spokesperson Mr. Luka Binniyat, comot confirm dis attack.
Di herdsmen still kill one man Atakshusho village, about three kilometers from where di initial attack happen.
Villagers been count 11 lifeless bodies following di attack and many people still dey miss.