Ghana don trowey Nigerian musician, Bella Shmurda, from dem country.
Dis one na sake of say him carry blow meet dem doctor wey do COVID test for am.
The bobo wey sing ‘Cash App’ been carry fork wan chuk doctor.
Him say the test result wey dem give am na fake.
Tori be say Bella Shmurda and him friends dem bin enta Ghana.
Ghana authorities com tok say dem must quarantine, com do test ontop.
As e dey be, Mr Shmurda no go fit enta Ghana for 3 months as di country don ban am from entering dem country.