For some days now, rumors dey fly say Niaja first lady, Aisha Buhari, get belle.
Pictures wey circulate social media been dey suggest so.
Di photos surface afta di first lady land for Abuja.
She just return from Turkey-Africa summit wey she go wit her husband, presido Muhammadu Buhari.
Some oda media report yan say di first lady get ailment wey make her belle big but no be pregnancy.


Mallam Hadi Uba, special assistant to di presido on administration, yan BBC say madam Buhari dey perfectly fine.
Him yan say reports of cancer or pregnancy na just mischief.
“I go tell you 100 percent say our first lady dey perfectly okay and no get disease or pregnancy as some dey report.
“Some of di reports na just from mischief makers wey no mean well, you know nowadays pipo fit tamper wit photos,” dis na wetin Mr Uba yan.



However di first lady bin carry mata go Instagram page to share some photos of wen she land for Abuja on Sunday.
Aisha Buhari, 50 years old, and presido Muhammadu Buhari, 79 years old, don already get five children togeda plus one grandchild.