Federal Inland Revenue Service (FIRS) don talk say make di people of Rivers State fashi Govonor Wike, continue to dey pay Value Added Tax (VAT) to dem.
Abdullahi Ahmad, Director, Communications and Liaison Department of di FIRS, yarn say people go see shege if dem no pay dem VAT to dem.
Court bin yarn say no be agent of di federal government, FIRS, suppose collect VAT but na Rivers State.
Oga Ahmad talk say FIRS go join bodi go court make dem for stop di judgement wey court done give Rivers State government.
As di matter dey hot, everybodi wan know who get di right to collect VAT and personal income tax. Na state government or na FIRS.
Meanwhile, FIRS done carry application go court say make dem delay di execution of di court order. Before dem go fit settle di matta once and for all.
Dem even tell court say make court use dem power stop everything wey Rivers state government wan do.
Mr ahmed don yarn di public say make dem calm dem body follow di VAT obligations until di matter don settle for court.