Ebonyi state Governor, David Umahi on Friday September 3rd, talk say him no go like am if Igbo man no emerge as APC Presidential candidate for 2023 general election.
Him tell Channels TV say for di sake of equity, fairness and justice, PDP or APC suppose to give South-East people chance to be president of this country.
South-East, Naija third-largest region dey dominated by Igbo people, but dem never produce President since (1999) wey Naija come back to democracy.
APC dey highly expected to comot North-West or South-West because of numbers.
Governor David Umahi never tok sey him wan comot as President but based on amebo for street, na because of the presidential race him shift post go APC last year.