Cristiano Ronaldo pot two goals as him return to Man Utd.
Him first goal na before half time as him just tap the ball inside net.
Javier Manquillo come equalize for Newcastle for second half.
Man Utd no gree on top di mata as C. Ronaldo nack dem another goal.
Match finish 4-1. Dis one done make Man Utd dey top di EPL table.
Di two other goals na from Bruno Fernandes and Jesse Lingard.
Di 36-year-old forward don return EPL with serious ginger as him tok sey no be vacation him come.