Suspected killer herdsmen don carry gun shoot Olajide Sowore, di younger brother of Sahara Reporters Publisher and activist, Yele Sowore.
According to Punch newspaper, na Sowore himself confam di tori ontop Facebook on Saturday.
“Suspected herdsmen/kidnappers don kill my younger brother wey dey follow me, Olajide Sowore as him been de go Igbinedion University for Edo sate where him be student of Pharmacy.”
“Dem just comot life from human being! Rest in Power, “Dr. Maniye!”
“This thing wey dem do no go delay justice,” Sowore write for him page.
We go bring una details later.