Big Broda Naija season 6 ex-housemate, Maria, don tok how she take enter di show as wildcard for dis #ShineYaEye season.
She follow Punch yarn on top di mata.
Maria tok say she no know say she go be wildcard till di day of di show.
But she still collect am because she love adventure even as directors tell her sey na 50/50 something.
As she reason am, she tok sey even if dem evict her for only one week, make she catch cruise for the Big Broda House.