Emmanuel don win ‘Head of House’ wit 26 point,
Hin come pick Liquorose as Deputy.
Pere follow am for back wit 15 points.
After di Head Of House games Big Broda carry pet fish take show housemates love.
Saskay collect dis gift with cry for eye.
She tok sey di gift touch her well well.
She no dull at all as she name her fish ‘Teka’.

Angel pray make her fish no die as she dey plan to get beta bond with am.
She follow ask Biggy if she fit carry di fish go house sake of sey e go pain her if person ever collect di fish from her hand.