BBNaija fans don vex say Boma and Tega dey do nyama-nyama things for Big Broda House.
Camera wey torch light dem, show say Boma dey spank and kiss Tega for executive lounge.
Dis na sake of say, Tega get husband and pikin for house before she come di show.
Boma and Tega kiss self during one task and e shock dia housemates.
Fans don vex trowey. Dem dey yarn say Tega pikin go grow come dey see him mama doings for TV.
E get fans wey dey wait make dem comot for the house make dem drag dem like small generator.