Naija authorities don announce say 38 Naija people wey di United Kingdom (UK) deport go land for Lagos airport today.
Among di 38 people na mothers and grandmothers wey don spend time for di kontiri.
Naija authorities tok say dis peoplego land for Lagos wit one controversial charter flight.
Sources also yan say be like some Ghanaian dey among di deported people.
Di Naija Ministry of Foreign Affairs tok say di UK deport dis people sake of Immigration related wahala.
Some of di deportees tok say dem don dey di UK for years
Authorities tok say some members of di LGBTQ+ also dey among people wey dem send back.
Di Human rights campaigners for UK don tok say dem dey worried about di health and well being of some of di deportees.
Dey tok say about 10 of di women get severe mental health problems and dem dey on medication.
Di human right people also add say dem believe say some of di people fit face persecution for Naija.
Di organisation say dis persecution fit be sake of dia religion or on dia sexual orientation.
On Wednesday Protesters gather for fornorth-east England to demand di release of di people wey dem plan deport.
But authorities for UK don tok say dem no fit allow people without papers remain di kontiri.